Nigeria Police Force don dismiss one Police Inspector, Richard Gele wey go viral inside one video recently wey show as im wan extort money from motorist and dey justify official corruption.
For inside di video, Gele tok say im get di support of im former commander to extort money from di public for highway.
“I no dey collect change, I no dey hide am, di IG sef know. My former commander say if you wan collect money, collect di one wey be say I go fit give am small if di case burst, no be di one wey only me go chop. He say collect beta money, im go follow me chop am and go defend me. So no be all dis change wey you dey give me. I no dey collect change. How much you wan give me, tok am? Na my customer be dis, na my market be dis, na here I dey sell.” Gele tok inside di video.
Di inspector until im dismissal dey attached to Police Mobile Force 77 Squadron, Okene, Kogi State and dem send am to Itobe – Anyigba Road, for safety of road users and motorists.
Police tok-tok pesin, Olumuyiwa Adejobi for inside statement say dem don de-kit and hand am over to di Kogi Commissioner of Police for further necessary actions.
📷 Nigeria Police Force
0 Comments